2017 CAF Champions League: How Wydad Casablanca beat Al Ahly

Dis na CAF champions league match between AL AHLY VS ESPERANCE

Wia dis foto come from, CAF

Wetin we call dis foto, CAF champions league na di biggest football for Africa.

Wydad Casablanca of Morocco don become African club champion after dem beat Al Ahly of Egypt 1-0 for second leg of di final wey dem play on Saturday.

Dis na di second time wey Wydad Casabanca go win di African Club title.

Ahly and Wydad bin play 1-1 draw last week for Alexandria's Borg El-Arab Stadium inside Egypt.

November 4 final game wey happen for Mohamed V Stadium, wey be Wydad Casablanca home ground inside Morocco, see dem beat Al Ahly wey don win di competition eight times before now.

Time table for di 2017 CAF Champions League second leg finals.

Wia dis foto come from, CAF

Wetin we call dis foto, Di CAF Champions League second leg finals start 8PM CAT on Saturday.

As winner of di CAF Champions League, Wydad Casablanca don get automatic ticket to play di Club World Cup competition next month for United Arab Emirates.